THE TEMPTATION OF BROS J.

28 Oct

1) As e dey hot! Bros J siddon e own jeje nai Holy Spirit carry am enter forest go set exam 4 am.

2) Bros J choose mind agree to fast for 40days and 40 nights. Afta e complete am…e eye kon dey red. As in e kon dey HHHHH.

3) Nai Devil gada mind…only am waka come, kon dey try Bros J patience. E 4get say ‘a hungry man is an angry man’.

4) E say if u be riri baba Godde pikin, Shenge dis stone to agege bread mak I see.

5) Bros J na sharp guy oh! E jus change am for man deve. E say u nor sabi read? say guy man nor dey hole e side wit only bread?

6) Say na only d correct yarns from baba Godde mouth nai be d koko? (But agege bread 4 dis condition nor be bad idea oh)

7) Man Deve kon look Bros J node head…nor be lie, u be sharp warri boy. U get mouth, but I nor go give up.

8) E kon carry bros J again go d highest church for area. E say if u beliv ursef say u be God pikin close eye mak u jump down.

9) me sef I read am say ur paale go send angels mak dem catch u lyk omomo…mak u nor fall lyk banga.

10) Bros J 1st look d distance well. E say: wey u, e go clear for your eye very soon oo…

11)…u neva hear say mak u nor dey test God temper? Sake of say e dey quick provoke (cc: consuming fire)?

12a) Devil nor still hear word…e get mind carry Bros J go top of d hiiigheeeest mountain.

12b) I nor even blame man deve, na Bros wey jus dey follow am as if na twitter.

13) Man kon show Bros J all d areas wey soft plus all d joli joli wey follow dem.

14) E say u see all dis arrangement? I go dash u every…jus gimme TWAILE! As in jus BUTU for me.

15) Bros kon parannoyed 4 man deve…e say b4 I close my eye open am fade comot here now!!!

16) Shebi u say u sabi read? U nor read am say na only baba Godde nai we go dey twaile for?

17) Wey u discharge comot here now, b4 I go change am for you!!!

18) Wen Bros J don pass exam finish nai some KFC angels begin land lyk Nigeria police afta d gbege don finish.

18b) Them arrange correct starch and banga soup follow body.

19) THE END.

Leave a comment